21/01/2026
Make una calm down and reason well, and verify 🚨
When dem forcefully collect one Igbo man shop for Abuja through Sharia court matter, na VDM stand gidigba follow am fight until the man collect him full investment back.
Nobody beg am. E do am because e believe say injustice no get tribe.
When NAFDAC wahala start for Onitsha market, and medicine dealers dey cry, na VDM waka go there stand with dem face to face. E no ask whether dem be this or that.
E stand for people wey dey oppressed.
When Igbo people get problem for Ghana, na VDM cross border go Ghana speak for dem.
E carry their matter go where e suppose reach. That one no be talk, na action.
So how come today, because Blord get personal issue with VDM, e wan turn am to tribal fight? How personal beef take become Igbo matter overnight? That logic no hold water.
This fight na between Blord and VDM. Make una leave am there.
No be Igbo versus anybody.
No be tribe against tribe.
Na two individuals get issue, and dem suppose settle am like adults.
Abeg, no let anybody use your brain